By: Seye Adenle
E don tey we dey this struggle
Yet the nation never bubble
This colonial container
Don tire to suffer
But e be like say we self no bother
Help us ask our prefects
Cheif servants messengers
Why dem no dey see beyond
Their nose
We get oil
We dey sell am out
We dey smuggle am
Everybody turn smugglers
We dey theif our own oil
We too big to be an entity
Gladiators say na lie
Oyinbo join us together
Say make we be in unity
Sake of say wetin dem see
How that go be?
Wey resources no equal
Wey ideology no alligns
Argument upon argument
Birth many coup
Many people too Ku
The situation no cool
We see palace coup
Counter coup
Phantom coup
Boot and beret too enjoy power
With force
Who go talk where gun dey?
Agbada vex say e want show
By all means kahaki clear chance
Since e enter power Neva balance
We are back to the same struggle
E still dey cause cassala
All of us get the national rice
But when we go come rise
When few hold spoons
Feed us with remnants
Dem say youth na future leader
Only them dey climb ladder
Them eat all we have today
Say make we hope for tomorrow
Where dem put us
Dem build fine fine house
With tall fence
Mr landlord dey fear
E no want make person
Thief wetin dem theif
Thief dey fear thief
Every person get dem government
To provide food for him family
Every person get him government
To provide food and shelter
I say every house get government
To provide generator bulb and noise
Every person get government
To provide health care
To provide schooling for
Them children
Oyinbo no tire to dey watch our game
Them say we be terrorists
Dem say we too corrupts
Dem say we too dull
We dey import toothpick
Join our problems
Dem say we no dey think
Only ogas
Dem dey pick all the fish
Say make we dey solve this equation
Natural resources plus human resources minus common sense is equal to human disaster
Revolution is near,it’s here and its now
God bless my country!
You & I can build a better Nation

Leave a comment